Ghosts suppose dae carry cord waka cos why not? Dem suppose get work for their burial and that work na to dae wipe people wey deserve am cord for neck.
You fit pause dae try reason why I yarn this thing but sip drink maidia. No be okoto dust I dae yarn.
No worry, we go join body reason am. Abi why you no go fit clap for pesin when e dae breathe, na when the pesin kpeme we go con dae hear appreciation. As per wetin? Mae we chop am?
If na after your husband die you start to dae shower am praise, you no do well. Wait, you no reason am say your husband fit die with mindset say hin be failed father as hin no too get weight for pocket?
If you no fit shower your friends praise now, you no do well. And no be only birthday time dem dae thank pesin.
Your mama and papa wey you suppose dae shower appreciation wey go dae make their head swell, do am now. No wait till you get money build house for them.
That your wife, your pikin, your neighbour, your relatives, dash them their flowers now. No hold am, nobody send you mae you keep am.
We don tire to dae see epistle after pesin don die abeg. Try dae give people their flower when dem still dae breathe. Yeah, mae their ghost no wipe you cord for neck.












Ingratitude is tantamount to stealing. I love when people are grateful in words and deeds. A little “thank you” goes a long way. I feel cheated when I do something for someone and they don’t appreciate. Let’s cultivate the attitude of gratitude.
Well said, Champ📌!